Wetin dey happen for We Obodo Nigeria?

 

According to tori wey dey online, Chikwado Eze don change address because him papa and one native doctor wey de call Onuwa, bury am alive for 4tification.

Dey be approve my guy visa recently, so him come go village for Ugbaike, Igbo-Eze north LGA, Enugu state, go tell him papa. 

But him papa say make dem go see native doctor for 4tification, so that him go make am succeed for abroad.

Native doctor say make dem bury Chikwado alive for 1hr30 minutes, after dat, dem go exhume am. But after 1hr30 minutes, dem exhume am, and Chikwado don kpai!

Police come, arrest him papa, Uwakwe, and native doctor. But people dey talk say the native doctor pikin na Okada man for the community. 

Abi him no wan make the man pikin rich pass e own?

Na situation of real bad belle be this one?

Abi na situation of person wey promise new cloth but e dey wear tear-tear cloth? 

May God rest Chikwado's soul. 

Share your moral lesson, abeg...

#streamingnaija

Post a Comment

0 Comments